mama naija see [POEM]
Page 1 of 1
mama naija see [POEM]
[red]mama naija see[/red]
Dis one no be poem
No be complain,no be song
Why pesin go begin sing
When 'im house de burn fire?
Bot na only mek you see
mama naija see.
See for instance,
Dose wey de overseethings
De carry things run overseas
Dem wey no get pens and chance
Don carry guns and charms
No be one pesin get oversea
mama naija see
Diz days no be only men
Sabi rob naija people
Women own don top chart
Bot that one na by-deway
Things don change sef!
Diz days na fowls de carry
Dem pekin go feed kite for mouth
Bot de 'tory be one say
Da whole world don see
Even me wey dey here as thief
'cos i am from here;mama see!
Na who talk say oyinbo no dey try?
Dem go thief am go oversea today
oyinbo go reton am tomorrow
Bot wetin i no like be say
Anoda big pesin go still kolet am
It no go even reach ground
Bot it go dey move like basketball
As you can see;mama naija see! (^_^)
Dis one no be poem
No be complain,no be song
Why pesin go begin sing
When 'im house de burn fire?
Bot na only mek you see
mama naija see.
See for instance,
Dose wey de overseethings
De carry things run overseas
Dem wey no get pens and chance
Don carry guns and charms
No be one pesin get oversea
mama naija see
Diz days no be only men
Sabi rob naija people
Women own don top chart
Bot that one na by-deway
Things don change sef!
Diz days na fowls de carry
Dem pekin go feed kite for mouth
Bot de 'tory be one say
Da whole world don see
Even me wey dey here as thief
'cos i am from here;mama see!
Na who talk say oyinbo no dey try?
Dem go thief am go oversea today
oyinbo go reton am tomorrow
Bot wetin i no like be say
Anoda big pesin go still kolet am
It no go even reach ground
Bot it go dey move like basketball
As you can see;mama naija see! (^_^)
Page 1 of 1
Permissions in this forum:
You cannot reply to topics in this forum
|
|
Sun Nov 11, 2018 4:13 am by Admin
» THINGS THAT ELEVATE AND DEPRESS MAN
Sun Nov 11, 2018 12:56 am by Admin
» A CHRISTIAN
Fri Nov 02, 2018 10:49 pm by Admin
» mama naija see [POEM]
Fri Nov 02, 2018 9:20 pm by Admin
» THE prof. travelling by sea
Sat Oct 27, 2018 5:41 pm by Admin
» GIRLS WAHALA
Sat Oct 27, 2018 6:05 am by Admin
» PASTOR AND DOLLAR
Sat Oct 27, 2018 5:30 am by Admin
» HOW TO SEND FREE CALL ME BACK
Sat Oct 20, 2018 4:47 am by Admin
» how to trace your phone without fear
Sat Oct 20, 2018 3:04 am by Admin